×
Sunday, August 30, 2026

EFCC new whistleblower policy fit make pesin multi-millionaire, but how similar policies work for past? - BBC

Published 16 minutes wey don pass

Read am in 6 mins

Di chairman of Nigeria anti-corruption agency, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), don announce anoda whistle blower policy wey dem tok say fit make pipo "multi-millionaire in your lifetime".

According to statement wey di EFCC release on Wednesday, oga Ola Olukoyede make di announcement wen e dey deliver lecture for di International Symposium on Economic Crime for Cambridge, United Kingdom.

Olukoyede tok say anybodi wey fit give di EFCC information wey go help dem recover moni wey pipo tiff from Nigeria and keep for abroad, dat pesit fit get betwin 2.5 percent and five percent of di total amount wey dem recover.

"Dis na incentive wey we don put in place to encourage pipo to come forward to give information about stolen assets. You neva know, if you give any information hia, some of you fit leave dis place, multi-millionaire in your lifetime," Olukoyede tok, according to di statement.

End of content

Buhari 2016 whistleblower policy

Di EFCC chairman, Olukoyede, no exactly tok weda dis im announcement na new policy, abi na continuation of di whistleblower policy wey don dey on ground since wen Muhammadu Buhari be di Preident of Nigeria.

For di Federal Executive Council meetin of 21 December 2016, just ova one year afta e bicom President, Buhari approve five percent reward to encourage pipo to report financial crimes and oda big corruption mata.

Kemi Adeosun, di Minister of Finance dat time, tell tori pipo...



Read Full Story: https://news.google.com/rss/articles/CBMiXEFVX3lxTE1velVqb09WbmZUUW9IcExxcjJu...