×
Thursday, May 14, 2026

Johnny Depp verdict: Johnny Depp win Amber Heard defamation case - BBC

Johnny Depp don win defamation case against im ex-wife American actress Amber Heard, wey im sue sake of claim of domestic abuse.

Di Jury bin find out say Heard defame her ex-husband in a 2018 Washington Post article where she bin write say she “be public figure representing domestic abuse”.

Di Jury find out say Heard statement about her marriage na "false" and e carri "a defamatory implication" to oda pipo apart from Depp.

Dem award Depp $10m (8m) in compensatory damages and $5m as punitive damages.

American actress, Amber Heard appear for court Wednesday as di jury don reach judgement on di defamation case against Johnny Depp.

As at now di actor, Johnny Depp dey for UK wia im go hear di verdict.

Na since last week, wey dem hear closing statements for case wey don grab di world attention by shirt.

Di court go hear di verdict on di seven questions of di case.

Many pipo don come to tok as witness for di case, including super model Kate Moss wey bin dey date Johnny Depp for di 1990s.

Mr Depp, 58, sue im ex-wife for $50m (40m) for an article she write in which she claim say she be abuse victim.

For December 2018, Heard write for one opinion piece for The Washington Post, describe her experience as a "public figure representing domestic abuse".

"I feel di full force of our culture wrath for women wey speak out," she write.

"I get di rare vantage point of seeing, in real time, how institutions protect men dem accuse of abuse."

She no mention her ex-husband or any oda alleged...



Read Full Story: https://www.bbc.com/pidgin/articles/cer9mpg0reno