×
Friday, July 11, 2025

Ogoni clean up: Shell ignore warnings of di 'wayo' about di clean-up - whistleblower tell BBC - BBC.com

Article information

  • Author, Simi Jolaoso
  • Role, BBC News, Ogoni
  • one hour wey don pass

A BBC investigation don uncover allegations say energy giant Shell don ignore repeated warnings say a controversial clean-up operation of oil-polluted areas of southern Nigeria get problems and corruption.

Di multinational wey get headquarters for London, along wit di Nigerian goment, don constantly tok say work to clean up oil-polluted sites of Ogoni, wey kick-off around eight years ago, dey go on well.

But di BBC don discover evidence say dem bin don get continuos warnings over several years say di scheme, wey goment set up and funded by various oil firms to di tune of $1bn (805m), don dey suffer from different issues.

One close observer describe di clean-up project as a "con" and a "scam" wey don waste money and leave di pipo of Ogoni for di Niger Delta region to dey live wit di serious impact of oil pollution - 13 years afta a ground-breaking UN report lift di cover on di seriousness of dia situation.

Shell tell di BBC: "Di operating environment for di Niger Delta still dey challenging becos of di level of illegal activities such as oil theft.

"Wen spills happun from our facilities we dey clean up and remediate, regardless of di cause. If na operational spill, we also dey compensate pipo and communities."

Di allegations come as a civil trial dey expected to begin on Thursday for di High Court in London, wia lawyers wey dey represent two Ogoni communities of around 50,000 inhabitants...



Read Full Story: https://news.google.com/rss/articles/CBMiXEFVX3lxTFA3aUgzSEliTXNXSDBidGZJcWo2...