×
Tuesday, January 27, 2026

Rape: I accuse one police officer say e rape ma, but na me end up on trial - BBC

Wen Ruth enta police station to allege say her partner don rape am, she no expect say she go end up for dock.

Police later accuse am say she make false allegation, charge her and put her for trial. E lead to years-long of struggle to clear her name, before dem finally free her.

Ruth, we don change her name to protect her identity, report di alleged rape for early 2020 - seven months afta she and di man, wey be police officer, don break up.

Di day wey di alleged assault happun, na di last time dem see each oda. "I feel say if I no report am, I no fit continue wit my life anymore," Ruth tell File on 4 Investigates.

Although di man wey dem accuse no face any charge, Ruth dey face accusation of perverting justice, wey fit carry life sentence.

For UK, only "extremely small number" of pipo evri year dey prosecuted for false rape claims, according to Crown Prosecution Service (CPS).

Di latest official figures from CPS show say for more dan one decade ago, ova a period of 17-month, between 2011-12, dem prosecute 5,651 for rape in England and Wales - but only 35 for making false allegations.

Around dat time, dem update di CPS guidelines, dis lead to false rape prosecutions dropping.

Pesin wey dem falsely accuse of rape before trial fit spend time for police cell or even prison.

If dem charge dem, dia name normally go dey public. Even pipo wey dem quickly clear fit face stigma.

Current CPS guidance tok say e dey important make police accept di damaging impact false rape allegation...



Read Full Story: https://news.google.com/rss/articles/CBMiXEFVX3lxTE9vVnh2c1pmeUt2YWFZODdZR3Jv...